Welcome to How to be a Nigerian – Where Every Naija Palava Na Vibe
Wetin dey sup?
If you dey read this tori, then you don jam correct blog wey go carry you go memory lane, back to those days of knockout during Christmas, pure water fights for school, and NEPA don take light again!
Welcome to How to be a Nigerian, where we share Stories from 9ja, a place where we go yarn the tori of wetin e mean to grow, hustle, and survive in the green-white-green jungle wey we dey call Nigeria.
This no be your regular blog oh, because I be original wafi pikin. This one na for the real 9ja pikin dem from the ones wey chop hot slap for not greeting elders, to those wey still dey battle JAMB wahala and ASUU strike. Whether you dey Lagos traffic dey shout “Oga shift small now!” or you dey Port Harcourt dey dodge flood like Olympics, your story get space here.
From early morning flogging to morning devotion (wey be like torture session), to sneaking out to watch African Magic while pretending to sleep we go touch everything. You remember how maale go use your full name shout from kitchen and your spirit go leave your body? Abi the way dem dey use I better pass my neighbor generator sound track chase sleep away every night?
We go talk about those aunty wey always dey form posh even though she sabi eat okpa and zobo like die. Or the uncle wey no dey ever drop money but always get advice like say na TED Talk.
If you don attend federal university before, normally you know say you deserve medal. The wahala dey plenty: course registration na war, lecturers fit no show for three weeks, and when exam reach dem go expect you to sabi everything from chapter one to 24 like say you be Google.
And who fit forget the hostel struggle sharing one small room with five people and one portable rat. Bucket war for bathroom, "Hold my space!" for class, and the ever-present danger of missing script even when you sabi book pass class rep.
But amidst the madness, we get vibes. From suya at 2am to jollof rice war at student union party. From crush wey no know say you dey exist to the roommates wey turn family. Na all these blend of drama and joy wey make the 9ja experience sweet and unforgettable.
Why This Blog?
Because our stories matter. Because sometimes, the only way to survive 9ja is to laugh through the tears. Because whether you dey Nigeria or you don japaa, you go always carry that Naija blood wey stubborn small.
So sit down. Relax. Share your own tori. Laugh, remember, and maybe even cry small. But most of all enjoy the journey.
Welcome to How to be a Nigerian.
Na here the matter go start.
Morning devotion was a dreaded 30 minutes for me... If you sleep you go wake up for heaven 😂
ReplyDelete🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣
DeleteEvery part of our lives in this country is a story…. Inside 9ja
ReplyDelete